Data from shipping expert Lloyd List put di value of di canal westbound traffic for roughly $5.1bn a day, and eastbound daily traffic at around $4.5bn. Di way e take hook dey affect oda ships wey dey try pass through di Suez Canal. Di canal wey separate Africa from di Middle East and Asia, na one of di busiest trade routes for di world. Suez Canal: How stakeholders take dey respond to di situationIf di delays dey short, most companies no go mind wait one extra day. Two major shipping companies, Maersk and Hapag-Lloyd, say dem dey find other options to avoid Suez Canal.
Source: GhanaWeb March 29, 2021 07:52 UTC