Di palace say "e dey very unlikely say e go dey possible to comot im bodi without say e disturb di resting place of plenti odas wey dey di area". Di statement add say di authorities for di chapel understand di need to honor Prince Alemayehu memory, but say dem also get "di responsibility to preserve di dignity of di departed". Dem also say before, di Royal Household bin don "allow requests from di Ethiopian delegation make dem visit" di chapel. Di prince bin dey ginger to go home, according to pesin wey Heavens quote but dem quickly bury di idea. Afta a decde for exile, di prince die for 1979 at di age of just 18.
Source: Ethiopian News May 24, 2023 06:20 UTC