BBC Pidgin of Monday, 12 April 2021Source: bbc.comNigeria Minister of communications, Isa Pantanmi don react to tori say im dey on United States watch-list for terrorism. Tori bin dey circulate for social media on Monday wit claim say di United States don black-list Communications Minister Isa Ali Pantami in connection wit global terrorism. One tori news platform bin quote US intelligence sources tok say before im appointment as minister, Isa Ali Pantami get "extremist views" about di United States, dem say im don pledge allegiance to al-Qaeda. Di minister tok-tok pesin, Mrs Uwa Suleiman, follow BBC Hausa tok say di article wey dem publish na to spoil di name of di minister. Di minister say no amount of intimidation fit stop am from implementing di good policies of President Muhammadu Buhari on security.
Source: GhanaWeb April 12, 2021 13:18 UTC