BBC Pidgin of Saturday, 3 April 2021Source: bbc.comNigerians dey react to ogbonge music producer Don Jazzy 'big' revelation say e bin marry almost 18 years ago at di age of 20. Inside Instagram post e make on Saturday, di ogbonge producer reveal say di marriage end for divorce wen e be 22 years because of im love for music wey no make am give im best for di marriage. Well truth na say almost 18 years ago I was 20 and I marry to my best friend Michelle @yarnstaswitch and e dey beautiful. But den sake of say I be dey so young and full of dreams I went and f***** it up cos I bin dey give all my time to my Music," Don Jazzy tok. Trending: Don Jazzy's Wedding Photos Surface pic.twitter.com/urr78v4COb — Punch Newspapers (@MobilePunch) April 3, 2021
Source: GhanaWeb April 03, 2021 12:33 UTC