All you need sabi about African Football League di continent newest elite club competitionWia dis foto come from, AFL Website7 hours wey don passAfrica new elite club competition, di African Football League (AFL), go kick off on Friday wen di opening game take place for Tanzania. Di AFL na new competition for di continent leading clubs, eight of whom go battle am out wit hope to win di $4million prize for di champions. Di brainchild of Fifa and im president Gianni Infantino, wey announce for February 2020 say di continent need one new pan-African club competition, di AFL - for im own words - "dey set to change di future of club football on di continent". Back in 2020, Infantino bin list some of di weaknesses e bin notice for African club football, say di continent lack "proper competition infrastructure" and existing tournaments such as di African Champions League and Confederations Cup be "30-40 times less successful dan Europe". Wit Fifa wey dey work in partnership wit di Confederation of African Football (Caf), di hope na say di AFL no go only raise di global profile of di continent clubs but also generate increased revenue.
Source: The North Africa Journal October 19, 2023 23:29 UTC