Afcon 2021: Why football teams dey carry food, water and oda tins go tournament7 January 2022Wia dis foto come from, Équipe du MarocMorocco na di tok of di 2021 Africa Cup Of Nations for Cameroon wey go begin two days time. The Atlas Lions of Morocco no stop dia, dem cari bed and mattresses follow bodi come di tournament. Dem still cari pipo wey go work for di hotel wey dem go stay for Yaounde too. Dem change di bedsheets and blankets for dia hotel wit di ones wey dem bring from dia kontri. "From dia, teams come begin start to cari dia own food dey travel for matches to make sure say las las dia teams dey okay" Oga Oyekale tok.
Source: The North Africa Journal January 07, 2022 19:19 UTC