Di landslides happun on Sunday evening and Monday morning, afta heavy rains fall for one remote mountain area of di Gofa zone. Di local authority tok say di search for survivors go "kontinu vigorously" but say di "death toll fit increase". Foto show say hundreds of pipo gather for di scene and oda dig in di dirt in search of pipo wey dey trap underneath. Gofa na part of di state wey pipo sabi as Southern Ethiopia, e dey around 320km (199 miles) south-west of di capital, Addis Ababa. For May 2016, at least 50 pipo die in floods and landslides following heavy rain across di south of di kontri.